E dey always sidan under one palm tree wey dey between Rama and Bethel for Efraim hill kountry and Israel pipol dey go der go meet am, make e judge dem.
So Gideon build one altar for der give God kon koll am, “Yahweh Shalom wey mean, ‘Na Oga God bi peace.’ ” Till today, di altar still dey for Ofrah wey bi Abiezer family land.
E get one man wey kom from Ramataim Zofim for Efraim kountry wey dey on-top hill and en name na Elkanah. Elkanah papa name na Jeroham. Elihu wey bi Tohu pikin, na-im born Jeroham and na Zuf wey kom from Efraim tribe, bi Tohu papa.
Di next day, Elkanah and en family wake-up for early morning go woship God, den dem kon go back to dia house for Rama. Elkanah sleep with en wife Hannah and God kon remember am.
So di pipol kon go Gilgal, di place where dem for make Saul dia real king for God present. Dem offa peace ofrin give God for der. Saul and evribody for Israel kon dey happy.
Naw, Samuel don die and evribody for Israel dey mourn. Dem beri am for en town for Rama. For dis time, Saul don porshu all di majik pipol and doz wey dey si vishon komot di town.
Di girls ansa, “Yes! Make una still waka go strait. But una go waka fast, bikos na today e kom di town and di pipol dey do sakrifice for di altar wey dey di hill.