Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




1 Samuel 6:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Wetin make una dey sturbon like Egypt pipol and dia king? Wen God ponish dem, dem nor sey make Israel pipol dey go?

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




1 Samuel 6:6
16 Iomraidhean Croise  

God too get sense and en pawa dey mighty; nobody fit stand against am.


God sey, “Make una nor sturbon as Israel pipol do wen dem dey Meribah and Massah wey dey di wildaness.


So Moses and Aaron go meet Fero kon tell am, “God wey bi Hibru pipol God sey: ‘Na how long e go take yu before yu go honbol yorsef for where I dey? Make yu let my pipol go woship mi!


But I go make Egypt sojas heart strong, so dat dem go porshu una and pipol go honor mi, bikos of wetin I go do to Fero, en shariot and doz wey dey ride dem.


All Fero shariot and doz wey dey ride dem kon porshu Israel pipol enter di Red Sea for dry land.


God tell Moses, “Wen yu go back to Egypt, yu must do all dis mirakle and sign for Fero front, bikos I don put pawa for yor hand. But I go make Fero heart strong well-well and e nor go gri free my pipol.


With all dis ones, Fero heart still strong well-well and e nor gri listin to dem, just as God tok.


God tell Moses, “Fero heart dey strong and sturbon and e nor go gri allow di pipol go.


But wen Fero si sey di wahala don end, en heart kon strong more and e nor gri listin to dem, just as Oga God tok.


But Fero heart still dey strong and sturbon as before and e nor gri free di pipol.


Dis na di rizin why I neva kill yu. I just won show yu my pawa, so dat pipol go praiz my name for evriwhere for di eart.


Wen Fero si sey di rain, ice-blok and di tonda don stop, e kon still sin again: both en and en savants kon get strong heart.


But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.


But make una dey enkourage one anoda evriday, so dat non of una go get bad mind, bikos of sin.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan