Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




1 Samuel 6:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Dis na di towns wey Filistia pipol leaders for bring di gold sore wey dem offa to God, so dat E go forgive dem dia sin: Ashdod, Gaza, Ashkelon, Gat and Ekron.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




1 Samuel 6:17
19 Iomraidhean Croise  

Make yu nor announce am for Gat or for Ashkelon strits. So dat Filistia wimen and di pipol wey dey woship juju, nor go happy.


Dis four men na Gat giant grand-shidren and na David and en men kill dem.


For dis time, Ahazaya fall from en ofis window for Samaria kon bigin sick. So e koll and send messenjas kon tell dem, “Make una go meet Baal-Zebub wey bi Ekron god kon ask weda I go die or not.”


Uzzaya attack Filistia pipol kon skata Gat, Jabneh and Ashdod wall. E build towns for Ashdod and all Filistia aria.


di strenjas for Egypt; di kings for Uz land; di kings for Filistia land, Ashkelon, Gaza, Ekron pipol and di pipol wey dem nor kill for Ashdod town;


“ ‘But if di pesin nor fit bring sheep or goat, e go bring two dove or two pijin as ofrin for di sin wey e kommit. One go bi for di sin ofrin and di oda one go bi burnt ofrin.


God sey, “Gaza pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol.


Make una go si wetin happen to Kalneh land, den pass der go Hamat-Rabbah and Filistia pipol town for Gat. Una nor si as dem distroy dem, abi una betta pass dem?


God go ponish una with boil from Egypt, some part for una body go swell-up, eczema, ring worm and kro-kro go full una body and dem nor go fit cure una.


Dem still attack Gaza, Ashkelon and Ekron town and di oda towns wey dey near der.


At wons God Spirit enter Samson kon make am strong, so e go Ashkelon kon kill thirty men, den e take dia klot, kon give dem to di men wey solve di problem. Leta, e go back to en papa and mama house kon dey vex bikos of wetin happen.


One day, Samson go Gaza wey bi Filistia pipol town and e stay der thru-out with one ashawo.


So Filistia pipol katch am kon blind en eye, den dem tie am with bronze shain; take am go Gaza kon force am make e dey grind korn for prison.


Naw, Filistia pipol don karry God Kovenant Box from Ebeneza go Ashdod.


So dem karry di box go Ekron, den di pipol for Ekron kon shaut dey sey, “Dem don bring Israel God Kovenant Box kom here, so dat e go kill awa pipol!”


So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Wetin wi go do to dis box wey bi Israel pipol God own?” Di leaders ansa, “Make dem karry am go Gat.” So dem kon karry di box go.


Dem kon ask, “Na wetin bi di ofrin wey wi go karry follow am?” Di priest and doz wey dey si vishon kon ansa, “Una leaders na five. So make una karry five gold sore and five gold rat, bikos na di same sickness do una with una leaders.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan