8 So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Wetin wi go do to dis box wey bi Israel pipol God own?” Di leaders ansa, “Make dem karry am go Gat.” So dem kon karry di box go.
Make una go si wetin happen to Kalneh land, den pass der go Hamat-Rabbah and Filistia pipol town for Gat. Una nor si as dem distroy dem, abi una betta pass dem?
But wen dat time rish, I go make Jerusalem bi like rock wey nobody fit move and all di nashons go gada togeda kon try to move am, but dem go just dey wound diasef.”
from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land
Den di men for Israel and Judah kon bigin sing war song. Dem porshu Filistia pipol go rish di valley and Ekron gate. Di Filistia man dead body dey groun for Shaaraim road wey dem dey pass go Gat and Ekron.
So Akish kon tell David, “I swear with God wey nor dey die sey, yu dey loyal to mi and na mi go happy pass sey yu follow mi go fight dis fight. I nor si anytin wey go let mi blame yu since di first day wey yu dey with mi kon rish naw. But di oda leaders bilive sey yu dey pritend.
So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Make una komot di Oga wey bi Israel God box from dis place! Make una karry am go back to where e dey before, so dat e nor go kill wi and awa pipol!” Di angel wey dey kill pipol dey di town dey waka and God dey ponish di pipol well-well.
Wen Ashdod pipol si wetin dey happen, dem kon sey, “Make dem komot Israel God Kovenant Box from here, bikos e don attack both wi and Dagon wey bi awa god!”
So Filistia pipol koll di priest and doz wey dey si vishon kon sey, “Wetin wi go do with di Kovenant Box? Make una tell us how wi go take karry am go back to where e suppose dey.”