7 Wen Ashdod pipol si wetin dey happen, dem kon sey, “Make dem komot Israel God Kovenant Box from here, bikos e don attack both wi and Dagon wey bi awa god!”
Fero savants ask am, “Na how long dis man go dey trobol us? Make yu free di pipol make dem go serve di Oga wey bi dia God. Yu nor know sey Egypt don distroy finish?”
Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”
Moab! Yu trust yor pawa and di many money wey yu get, but naw, yu go die and strenjas go karry Kemosh wey bi yor god, en prince and priests, go anoda land.
God really attack di pipol wey dey stay Ashdod and E kause betta wahala for dem. God put sore for all di pipol body, both doz wey dey Ashdod and doz wey dey stay near der.
So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Wetin wi go do to dis box wey bi Israel pipol God own?” Di leaders ansa, “Make dem karry am go Gat.” So dem kon karry di box go.
Di pipol wey dey stay Bet-Shemesh kon ask, “Na who go fit stand before di Oga awa God wey dey holy? Na where wi won send di box go, so dat God go leave us?”