So dem take one melu as Elijah tok kon kill-am put on-top di firewood wey dem arrange. Dem koll dia juju, Baal name from morning go rish aftanoon kon dey sey, “Baal! Make yu ansa us o-o.” But e nor ansa dem, even as dem dey jump anyhow for di altar wey dem make.
Dem get hand, but dem nor fit tosh or feel anytin. Yes! Dem still get leg, but dem nor fit waka. Dem even get trot, but dem nor fit klear am or make any sound.
But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.
Dat same nite, I go pass thru Egypt kon kill all di first-born son inside Egypt, both human being and animals, den I go judge all di gods for Egypt. Na mi bi di Oga una God.
Di karpenters among dem dey enkourage doz wey dey make gold and di man wey dey karve di juju dey tell di one wey dey nail am togeda sey, ‘I like as yu nail am strong so, bikos e nor go fall.’
Dem go karry am for dia shoulder dey waka kon go put am for where e go dey. E nor go fit komot for where dem put am. Even wen pesin pray to am, e nor go fit ansa or save di pesin from wahala.
Una go make image wey bi like di sore and rat wey dey distroy di whole land, den kon honor Israel God. May bi E go sorry for una, una gods and una land.