Una wey bi leaders and my pipol shepad, make una shaut kry well-well! Make una mourn and roll for san-san, bikos di time don rish wen dem go kill una kon kut una like goat
E go bi like pesin wey run hide bikos of lion, but where e hide put or run enter, na tiga e go meet for der! Or like pesin wey run go hide for house, but as e put en hand for wall, snake kon bite am!
“For dis time tumoro, I go send one yong man kom meet yu from Benjamin tribe. Yu go anoint am kon make am king ova my pipol, Israel. E go save dem from Filistia pipol hand. Bikos I don favor my pipol and dia prayers don rish my ear.”