4 God kon koll Samuel and e ansa, “Na mi bi dis!”
So afta sometaim, God kon test Abraham. God koll am, “Abraham!” Abraham ansa, “Na mi bi dis!”
But God angel koll am from heaven, “Abraham! Abraham!” Abraham ansa, “Si mi for here!”
Moses and Aaron dey among en priests; Samuel na one among di pipol wey pray to am. Dem pray to God and E ansa dem.
Wen God si sey Moses don near di bush, E kon koll am, “Moses, Moses!” Den Moses ansa, “I dey here.”
Den I hear God ask, “Who I go send? Who go bi awa messenja?” So, I kon ansa, “I go-go! Make Yu send mi!”
E fall for groun kon hear one vois wey koll en name, “Saul, Saul, wetin make yu dey ponish mi?”
So for di church, God first choose apostles, before profets and tishas. E still choose some wey dey do mirakle, odas wey dey heal sick pipol, some wey bi leaders and odas wey dey tok with difren-difren language.
Den e run go meet Eli kon sey, “Si mi here, yu bin dey koll mi.” But Eli sey, “I nor koll yu. Make yu go back go sleep.”