1 Samuel 26:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
6 David tell Ahimelek wey kom from Hit and Abishai; Joab broda wey kom from Zeruaya sey, “Who go follow mi go meet Saul for en kamp?” Abishai kon ansa, “I go follow yu go.”
Una don forget how dem take kill Abimelek wey bi Gideon pikin? Na for Tebez, one woman trow stone from di wall kon kill-am. Why una go near di wall like dat?’ If di king ask yu dis tins, den make yu tell am sey, ‘Uriaya wey bi yor offisa, don die too.’ ”
Joab wey en mama name na Zeruaya and David ofisas kon meet demsef for di pool for Gibeon. All of dem sidan; one set dey for one side for di pool and di oda set dey for di oda side.
Joab broda, Abishai wey dia mama na Zeruaya, na leader for di three. E use en spear take fight against three hundred men kon kill dem and en name dey famous among di three.
bikos God don make Siria sojas hear nois like sey many sojas with dia shariot dey kom fight dem. So Siria sojas tell demsef, “Si, Israel king don go hire Hit and Egypt kings with dia sojas, so dat dem go kom attack us.”
Joshua sey, “Na like dis una go take know sey, God wey nor dey die dey with una and E go really porshu Kanaan, Hit, Hiv, Periz, Girgash, Amor and Jebus pipol komot for una.
So David and Abishai kon rish der dat nite and dem si sey Saul dey sleep inside di kamp and e pin en spear for groun near en head. Abner and di sojas sleep around am.