1 Samuel 26:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
5 So David kon go di place where Saul kamp put. E si where Saul, Ner pikin Abner and en sojas sleep put. Saul sleep inside di kamp, while en sojas kon sleep round am.
Wen Abner rish Hebron, Joab take am go di gate side like sey e won tok to am where nobody go hear, den e shuk Abner for belle. Na so e take kill Abner, bikos e kill Asahel wey bi en broda.
So David get up before day break kon give en papa animal to pesin make e guide dem. Afta e don pak evritin, e kon go just as Jesse tell am. E rish di kamp as di sojas dey go di war front and dem dey sing war song.
As Saul dey wosh David dey go fight di Filistia man, e kon ask Abner wey bi di sojas oga sey, “Abner! Na wish pesin pikin bi dis sef?” Abner ansa, “My king, I nor know.”
E get one man from Benjamin tribe, en name na Kish and en papa na Abiel wey Zeror born and na Bekorat wey en papa na Afia from Benjamin tribe, born Zeror. Dem know Kish well-well for evriwhere.