25 So Saul ansa David, “My pikin! Make God bless yu. Yu go dey prosper for evritin wey yu do.” So David go en own way and Saul kon go back.
Den di man sey, “Dem nor go koll yu Jakob again, but from today go, na Israel dem go dey koll yu, bikos yu don fight with God and man and yu don win.”
Even doh e tok sweet words, make yu nor bilive am, bikos na wikedness full en belle.
But nor-tin wey pipol use against una, go fit distroy una; una go ovakom evribody wey dey akuiz una. Dis na wetin pipol wey dey serve Mi dey enjoy and I go defend and make dem win.” Na so God tok!
E fight with God angel kon win. E beg di angel make e bless am. E meet God for Bethel and God kon tok with am for der.
Na who go fit separate us from Christ love? Na trobol or opreshon; honga or poverty; wahala or deat; or na bikos klot nor dey to wear?
Inside all dis tins, awa joy don dey full, bikos Jesus love us!
If pesin katch en enemy, e dey tell am make e go without sey e wound am? Today! Make God reward yu with good, bikos of wetin yu do to mi.
Si naw, I don know sey na yu really go bi king and yu go build Israel kingdom with yor hand.
David kon promise Saul. Den Saul kon go en house and David and en men kon go where dem go for dey save.