Di tin make Abner vex well-well and e kon sey, “Yu tink sey I go betray Saul? Yu tink sey na Judah I dey serve? I always dey respet Saul wey bi yor papa, en broda and en friend and I make sure sey David nor win una. But today, yu sey I dey sleep with yor papa girl-friend!
Afta, wen David go greet en family for house, Mikal kom meet and tell David for outside sey, “Israel king don fool ensef well-well today! E disgrace ensef for en girls savant and ofisas front!”
But with evritin wey I tok, una plant wikedness kon harvest wetin una plant. Una don chop di fruit wey una lie-lie kause. Bikos una trust una shariot and di many sojas wey una get,