Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




1 Samuel 2:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 E dey make some poor kon make odas rish. E dey honbol some kon make odas great.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




1 Samuel 2:7
17 Iomraidhean Croise  

So Jehu stand up, follow am go inside. Den di profet pour di olive oil for en head kon sey, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok, ‘I don choose yu as Israel king.


Na from Yu money and propaty from dey kom. Na yor strent and pawa Yu take dey rule evritin and Yu fit make anybody big and strong.


King Hezekaya get money well-well and pipol dey respet am. E build where dem go dey keep en silva, gold, precious stones, spices and many oda tins wey e get, put.


E build royal towns and e get many sheep and melu, bikos God gi-am many propaty.


Den e sey, “Dem nor born mi with anytin and wen I die, I nor go karry anytin follow body. Na God dey give and E don take. Make wi praiz God name!”


Yes! Look dem, make yu bring dem kom down kon skata where wiked pipol stand put.


Na God dey karry doz wey dey honbol go up and give joy to doz wey dey mourn.


bikos of di way Yu dey vex for mi. Yu don pick and trow mi go down.


bikos na God dey judge! E dey bring one pesin down and karry anoda pesin up.


One cup wey full with wine wey dem mix with spice, dey for God hand and E pour am for di world. True-true, all di wiked pipol for di world go drink from am till e finish.


Pesin wey get plenty money and pesin wey nor get, na di same dem bi, bikos na God kreate two of dem.


True-true, God wey dey lead di sojas for heaven don plan di day wey E go judge evritin, bikos E go disgrace di pipol wey feel sey dem get pawa and dey make mout.


God go make una weak among oda nashon and nobody go respet una again.


Evry tree for di land go know sey na mi bi God. I go kut di trees wey tall and di ones wey short, I go make dem tall. I go make green trees dry kon make dry trees, green. Mi wey bi God don tok and I go do wetin I sey I go do.”


If una put una body down for God, E go karry una go up.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan