kon sey, “Dis na di place where di priest go boil di meat, wey dem go offa as sakrifice for sin ofrin and na der dem go for bake di bread too, so dat dem nor go karry anytin wey dey holy go outside di kourt kon kause trobol for di pipol by mistake.”
Dem go put am inside di pot, basin or kettol and anytin wey di fork bring kom out, go bi di priest own. Dis na wetin dem dey do to all Israel pipol wen ever dem kom Shiloh.
Naw, wen Eli don old well-well, e kon dey hear evritin wey en boys dey do to evribody for Israel and how dem dey sleep with wimen for di temple door-mot.
So wetin make dem get long-trot for di sakrifice and ofrin wey I sey make dem put for where I dey? Eli, yu don honor yor boys pass mi, bikos yu don make dem fat from di best part of meat from all di ofrin wey my pipol for Israel dey bring.’