Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




1 Samuel 19:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Naw, David don run go hide. E run go meet Samuel for Rama kon tell am evritin wey Saul do am. Den en and Samuel kon go stay Naiot.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




1 Samuel 19:18
11 Iomraidhean Croise  

As I dey vex, I kon sey, “Evribody dey lie well-well!”


So make una konfess una sin to each oda. Make una pray for each oda, so dat God go heal una. Di prayer wey pesin wey good for God eye take all en mind pray, dey work well-well.


Di next day, Elkanah and en family wake-up for early morning go woship God, den dem kon go back to dia house for Rama. Elkanah sleep with en wife Hannah and God kon remember am.


Samuel kon go Rama, while Saul go en house for Gibeah.


Dem kon tell Saul sey, “David dey Naiot for Rama.”


Den Saul kon go Rama by ensef. Wen e rish di big well for Seku, e kon ask, “Where Samuel and David dey?” Dem ansa am, “Dem dey for Naiot wey dey Rama.”


So Saul go Naiot for Rama. God Spirit kon enter en body and e kon bigin tok wetin go happen as e dey waka till e rish Naiot for Rama.


David run go Naiot for Rama. E go meet Jonatan kon ask am, “Na wetin I do? Na wish bad tin I do? Na how I take sin against yor papa? Bikos e won kill mi!”


King Akish savant kon ask di king, “Nor bi David bi dis, David wey bi king for en kountry? Nor bi en pipol dey sing sey, “ ‘Saul kill 1,000, but David kill tazon plus tazon.’ ”


Naw, Samuel don die and evribody for Israel dey mourn. Dem beri am for en town for Rama. For dis time, Saul don porshu all di majik pipol and doz wey dey si vishon komot di town.


Den e go kom back to Rama, bikos en house dey der. E still dey judge Israel pipol for der and e build one altar for der wey dem for dey woship God.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan