16 Wen di pipol rish der, dem kon si only di doll-baby for di bed wey dem put goat hair for en head.
Den Mikal take one doll-baby for di house kon put am for bed. E put goat hair for di doll-baby head kon kover am with klot.
Den Saul send pipol go back sey, “Make una karry am kom like dat, so dat I go kill-am with my hand.”
So, Saul tell Mikal, “Wetin make yu deceive mi like dis kon make my enemy run? Naw, e don eskape.” Mikal kon ansa, “E sey, ‘If yu nor help mi run, I go kill yu before yor papa kill mi.’ ”