Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




1 Samuel 18:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Dis tin kon make Saul dey vex. E nor like di word wey di wimen dey tok and e kon tink for en mind sey, “Dem dey sey David don kill tazon times tazon pipol, but mi, only 1,000. Wetin e nor get escept di kingdom?”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




1 Samuel 18:8
16 Iomraidhean Croise  

Josef brodas kon dey jealous am, but wetin Josef tok, en papa keep am for mind.


Den en brodas ask am, “So yu really tink sey yu go rule ova us or get pawa pass us?” So dem kon hate am more-more, bikos of di dream and wetin e tok.


Di king ask, “Why yu sey make I give Abishag to am? Yu for still ask sey make I gi-am di throne too, since e bi my senior broda and Abiatar di priest and Joab dey en side!”


Wen Haman si sey Mordekai nor gri bow or gi-am respet, e vex well-well


To dey karry body up, dey kause wahala, but doz wey dey take advise, wise well-well.


Vexnashon bad and anga dey distroy tins, but who fit stand and bear jealousy?


Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.


Di pipol kon dey komplain to God about dia problem. Wen God hear dem, E vex, so E send fire kom from heaven kon burn and distroy some part for di kamp.


Balaam kon tell God angel, “I don sin. I nor know sey yu stand against mi for di road. So if wetin I dey won go do nor dey good for yor eye, I go-go house back.”


Abi yu tink sey God nor mean wetin E tok wen E sey, “Di Spirit wey I put inside una dey jealous well-well?”


But naw, yor kingdom go end. Bikos yu nor obey am; God go fine di kind pesin wey E wont kon make am king wey go rule en pipol.”


So, Samuel kon tell am, “God don tear Israel kingdom komot from yor hand today and E don gi-am to pesin wey betta pass yu!


So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.


So Saul kon dey look David one kind from dat day go.


Den Saul tell en pikin Jonatan and all en savants sey make dem kill David. But Saul pikin Jonatan like David well-well.


Yu nor know sey as long as David dey alive, yu nor go ever bi king for Israel? Naw, make yu go bring am kom here, bikos e must die!”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan