David go meet dem kon sey, “If una kom like friends kon help mi, den I go make agriment with una! But if una kom sell mi give my enemies wen I nor tosh or wound una, make awa grand-grand papa God si evritin kon judge una.”
Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.
But di sojas sey, “Make Jonatan wey win dis war for Israel, die? E nor go ever happen! As long as God dey alive, one hair for Jonatan head nor go even fall rish groun! Bikos na with God help, e take do wetin e do today.” So di sojas nor let dem kill Jonatan.
So e kon tell David, “My papa dey try to kill yu. So make yu take kare as yu dey waka for morning and find somewhere go hide and make yu stay der alone.
Abeg, make yu do dis favor for mi, bikos yu don promise yor savant with God name. If I do wrong, na yu go kill mi my yorsef! Wetin go make yu take mi go meet yor papa?”
Nobody fit kon even tell mi wen my own pikin enter agriment with dis David. Non of una even fit sorry kon tell mi sey my own pikin don allow my savant set trap for mi, just as e bi today so.”