Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




1 Samuel 17:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Wen Israel men si Goliat, dem go hide, bikos of fear.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




1 Samuel 17:24
9 Iomraidhean Croise  

Only one of una enemies soja go kill 1,000 of una, den wons una si five of una enemies sojas, all of una go run until una nor many again kon small like poles wey dey on-top mountin or sign flag wey dey on-top hill.”


So some pipol kon tell Judah king sey Siria sojas dey for Israel aria, den en and all en pipol kon dey fear, sotey dem bigin shake like tree wey breeze dey blow.


“I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una.


and wi even si some giant for der (wey bi Anak shidren-shidren) and wi bi like ant for dia front.”


How one pesin go fit porshu 1,000 among dem and two pipol porshu 10,000; if nor bi sey dia Rock sell dem and dia God give dem to dia enemies?


Wen Saul and Israel pipol hear wetin di Filistia man tok, dem vex well-well and fear kon dey katch dem.


As e dey tok to dem, Goliat di Filistia champion wey kom from Gat kon kom out from Filistia pipol side. E tok as e always dey do and David kon hear am.


Di men for Israel kon sey, “Yu si dis man wey dey kom out always? E dey do like dis to shalenge all Israel. But awa king don sey, ‘Anybody wey go fit kill di man, e go gi-am money and en dota make e marry and di pesin papa house nor go dey pay tax again.’ ”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan