1 Samuel 15:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
3 So make yu go kill Amalek pipol. Yu go distroy evritin wey dem get. Nor leave anybody or anytin. Kill evribody both man, woman, yong pikin, melu, sheep, kamel and donkey.’ ”
Den God tell Moses, “Make yu rite dis tin for groun, so dat pipol go remember am, den tell Joshua sey, mi wey bi Oga God go make sure sey Amalek pipol nor go dey dis world again.”
Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
Dem enter di town, katch di king and all di towns wey dey near am, den dem kill evribody wey dey stay der; nobody survive. Dem kill evribody, just as dem do for Hebron, Libnah and to dia kings.
Saul and en sojas nor kill king Agag and dem nor distroy di betta tins and animals. Dem nor kill all di animals, but dem kill and distroy di tins wey nor good for di town.