2 Dis na wetin God wey dey heaven dey tok: ‘I si as Amalek pipol dey trobol Israel pipol, wen dem dey kom out from Egypt.
Elifaz wey bi Esau pikin, en girl-friend Timna kon born Amalek for am. Dis na di sons wey Esau wife Adah, born.
Gebal, Ammon and Amalek pipol with doz from Filistia and Tyre.
“Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before. Mi, wey bi God, don tok.”
Dem nor know sey, I remember all di bad-bad tins wey dem do. Dia sin plenty well-well and I dey si all di wiked tins wey dem dey do.
Naw, Oga God swear with en name sey: “I nor go forget all dis evil tins wey una don do.
Den Balaam look Amalek pipol kon profesai: “Before-before, na Amalek strong pass among di nashons, but e go skata forever.”