1 Samuel 13:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
4 Israel pipol hear sey Saul don kill Filistia sojas wey gada for Gibeah and Filistia pipol kon hate dem. So all Israel pipol kon go join Saul for Gilgal.
Den Jakob tell Simeon and Levi sey, “Una don turn mi to dirty wey dey smell to di pipol for dis land, Kanaan pipol and Periz pipol, bikos of di wahala wey una put for my head. My pipol nor plenty and if dem gada demsef kon attack mi, dem go distroy both mi and my family.”
Den make una tell am sey, ‘Yor savants dey kare for animals since wi bi small pikin kon rish naw, both wi and awa papa.’ Make una tok like dat, so dat una go fit stay for Goshen land, bikos Egypt pipol nor like pipol wey dey kare for animals.”
Wen Ammon pipol si sey dem don make David vex for dem, dem kon go Aram Bet-Rehob and Aram Zobah go hire 20,000 sojas wey dey waka for groun, plus 1,000 men from Maaka king and 12,000 men from Tob.
“Yu go-go Gilgal before mi. I go kom meet yu for der kon offa ofrin and make peace ofrin for der. Yu go wait for seven days, until I go kom tell yu wetin yu go do.”