1 Samuel 13:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
3 Leta, Jonatan kill Filistia sojas for Gibeah and all Filistia pipol kon hear about am. Den Saul blow trumpet take koll all di Hibru pipol make dem kom fight.
E get one man for Gilgal wey dem dey koll Sheba, na Bikri bi en papa wey kom from Benjamin tribe. E blow trumpet take koll di pipol kon sey, “Make David get out! Wi nor go follow am again! Israel men, make wi dey go awa house!”
All di land from Gibeah aria go rish Rimmon wey dey di sout, go klean like Arabah. But Jerusalem go high pass oda land wey dey round am; di town go start from Benjamin Gate go rish di Korna Gate kon from Hananel Towa go di Royal Wine press.
“Den yu go-go God hill for Gibeah where Filistia pipol ofisas dey. Wen yu enter di town, yu go meet some profets wey dey kom down from di altar for di hill. Dem go karry harps, sheke-sheke, wiso and lyres and dem go dey tok about wetin go happen.