Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




1 Samuel 13:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Saul selet 3,000 men from Israel for ensef. 2,000 from di men, dey with Saul for Mikmash and for Bethel kountry for di hill; while di remainin 1,000 dey with Jonatan for Gibeah for Benjamin. E kon send di rest pipol go house.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




1 Samuel 13:2
24 Iomraidhean Croise  

E get one man for Gilgal wey dem dey koll Sheba, na Bikri bi en papa wey kom from Benjamin tribe. E blow trumpet take koll di pipol kon sey, “Make David get out! Wi nor go follow am again! Israel men, make wi dey go awa house!”


So make yu give us seven of en grand sons and wi go hang dem give God for Gibeah, wey bi Saul, di king wey God choose town.” Di king ansa, “I go give una.”


Heled wey bi Baanah pikin wey kom from Netofat; Ittai wey bi Ribai pikin wey kom from Gibeah for Benjamin tribe;


Some pipol from Benjamin tribe dey stay for Gibeah, Mikmash, Aija and Bethel with di arias for der.


Zela, Haelef, Jebus pipol town (wey bi Jerusalem), Gibeah and Kiriat. Dem bi fourteen big and small town. All dis na di land wey Joshua give Benjamin tribe.


Joshua give dem gift kon tell dem make dem go back to dia house.


But di masta sey, “No! Wi nor go fit stay for dis town wey Israel pipol nor dey, instead wi go-go Gibeah.


Even Saul sef go en house for Gibeah. But some strong men wey God don tosh dia heart, follow am go en house for Gibeah.


“Den yu go-go God hill for Gibeah where Filistia pipol ofisas dey. Wen yu enter di town, yu go meet some profets wey dey kom down from di altar for di hill. Dem go karry harps, sheke-sheke, wiso and lyres and dem go dey tok about wetin go happen.


Saul na thirty years wen e start to rule; e rule for more dan forty years.


But Samuel sey, “Wetin yu don do so?” Saul ansa, “Wen I si sey di sojas don dey run leave mi and yu neva kom for di time wey yu suppose kom and I hear sey Filistia pipol don gada for Mikmash,


Den Samuel go Gilgal and from der to Gibeah for Benjamin. Saul shek di sojas wey still dey with am and dem bi like six hundred.


So Saul, en pikin Jonatan and di sojas wey dey with am kon kamp for Gibeah for Benjamin, while Filistia pipol kamp for Mikmash.


Filistia pipol kon send some sojas make dem go block Mikmash road.


Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven.


Dat day Israel sojas kill Filistia pipol from Mikmash go rish Aijalon and dem kon taya.


Di rock wey face nort dey near Mikmash and di oda one wey dey sout dey near Gibeah.


All di time wen Saul dey alive, e always dey fight with Filistia pipol. So wen ever Saul si pesin wey strong and get mind, e go add am join en sojas.


Samuel kon go Rama, while Saul go en house for Gibeah.


E rish one place where sheep dey for di road side and rock wey whole dey inside, dey der too. Den e go inside di rock go rest. Naw, David and en men sidan for di rock back (Dem hide for der).


So Saul take 3,000 strong sojas wey e selet from Israel kon go find David for Zif desert.


E sey, “E get di way di king go take rule una; e go turn una shidren to sojas; some of dem go bi savant for en shariot and odas go dey run follow di horse.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan