Before di days finish, for di twenteth day for di ninet mont, all di pipol wey dey stay for Judah and Benjamin aria kom gada for Jerusalem for di temple front. Heavy rain dey fall, so evribody kon dey fear, bikos of di weda and di matter wey make dem gada.
Di day wey God put Amor pipol for Israel pipol hand, dat day Joshua pray to God for Israel pipol front sey: “Yu sun, make yu stay for where yu dey on-top Gibeon! And make di moon nor near dis side, just stay for where yu dey for Aijalon Valley!”