Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




1 Samuel 12:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Naw make una look! Na di king wey una choose bi dis; di king wey una ask for. Si, God don give una king.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




1 Samuel 12:13
9 Iomraidhean Croise  

Na mi vex give una kings and I still vex take dem komot.


Di pipol kon ask for king and God give dem Saul, wey bi Kish pikin, wey kom from Benjamin tribe and e rule dem for forty years.


Samuel tell di pipol, “Una don si di pesin wey God don choose? True-true, nobody bi like am for di whole Israel!” All di pipol kon shaut, “Di king go stay forever!”


So di pipol kon go Gilgal, di place where dem for make Saul dia real king for God present. Dem offa peace ofrin give God for der. Saul and evribody for Israel kon dey happy.


Abi nor bi di time to harvest grain bi dis? I go koll God, so dat E go send betta tonda and rain kom. Make una open una eye kon si how una don sin rish, wen una ask God for king wey go lead una.”


Dem kon tell Samuel, “Make yu help us pray to God, so dat all of us nor go die, bikos wi don add join awa sins, wen wi ask for king.”


kon tell am, “Si, yu don old and yor shidren nor dey do as yu dey do. So make yu choose king wey go lead us, just as all di oda nashons get.”


Make yu nor worry about di donkey dem wey lost three days ago, bikos dem don si dem. But na who Israel pipol dey look for? Na yu and evribody for yor papa house?”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan