I go kom down kon tok with yu, I go take some of di Spirit wey dey inside yu kon put am inside dem and dem go help yu karry some of di wahala so dat yu nor go karry am on yor own.
God kom down for di kloud kon tok to dem. E take some of di Spirit wey dey inside Moses kon put dem inside di seventy men. Wen di Spirit enter dem, dem kon dey profesai, but dem nor do like dat again.
Two out of di seventy men, Eldad and Medad kon stay for di kamp and dem nor go where di Tabanako dey. But di Spirit enter dem for where dem dey and dem kon start to profesai too.
For dat day wey God go judge evribody, many pipol go sey, ‘Oga God, wi use yor name prish God message, drive many demon komot from pipol body and do many mirakle.’
As Samson rish Lehi, Filistia sojas kom dey happy dey shaut. At wons, God pawa enter Samson and e kut di rope wey dem take tie am like sey na tread wey dey burn.
So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.
So Saul send men go katch David kom. Wen di men si some profet dey tok wetin go happen with Samuel as dia leaders, God Spirit kon enter dem and demsef kon dey tok like di profets.