“As yu dey go from here, yu go rish dat tall tree for Tabor. Dat time, three men wey dey go meet God for Bethel, go meet yu. One of dem go karry three bread and one go karry one kontaina wey get wine.
“Den yu go-go God hill for Gibeah where Filistia pipol ofisas dey. Wen yu enter di town, yu go meet some profets wey dey kom down from di altar for di hill. Dem go karry harps, sheke-sheke, wiso and lyres and dem go dey tok about wetin go happen.