25 Samuel tell di pipol how di king go work. E rite evritin down for book kon put am for God present. Den Samuel sey make evribody dey go dia house.
Den Jehoiada with di king and di pipol kon make kovenant sey, na only God dem go always dey serve.
“Make una take di Law Book kon put am near di Oga una God Kovenant Box. E go dey der as witness against una,
Make una pray for kings and doz wey dey rule, so dat wi go fit live for peace, get betta karata and good life with fear for God.
Make yu remind di bilivers sey, make dem respet doz wey dey rule dem. Dem must obey and dey ready to do good.
Joshua give dem gift kon tell dem make dem go back to dia house.
Samuel tell di pipol, “Make una kom make wi go Gilgal go crown Saul.”
So naw, make yu do as I tok. But make yu warn dem well-well kon make dem know evritin about how di king go rule dem.”