3 Evry year, Elkanah dey from en town go woship and sakrifice to God for Shiloh. Na der, Eli two pikin (Hofni and Finehas) dey for serve God as priest.
For evry year, evry man for Israel go dey celebrate dis three feast: Bread wey nor get yist, Harvest Feast and Shelta Feast. For each feast, evribody must karry gift kom give di Oga una God for di place wey E choose.
Den, dem tink of di sakrifice wey dem dey do for God and na evry year for Shiloh, wey dey sout for Lebonah and nort for Bethel, dem for dey do am. E still dey east for di road wey dey between Bethel and Shekem.
So one day wen dem go Shiloh, afta dem don chop and drink finish, Hannah stand up kon go pray. (Dat time Eli wey bi priest sidan for en chair wey dey God Temple door-mot.)
(Di priest wey wear di priest garment na Ahijah wey bi Ahitub broda Ikabod pikin and na Finehas wey Eli di priest for Shiloh born, na-im bi Ahitub papa.) Di men nor know sey Jonatan don leave dem.
So dem send some sojas go Shiloh go karry God Kovenant Box wey dey for di cherubim centre. Eli two boys pikin, Hofni and Finehas, dey der with God Kovenant Box.