Psalms 98 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishNa God Dey Rule Di World 1 Make una sing new song for God, bikos E don do wonderful tins! E dey diliver pipol with en rite and strong hand. 2 God show en pawa to diliver and en goodness to evribody! 3 E don remember en promise to love and kare for Israel pipol and di whole eart don si God viktory. 4 So make all di eart shaut to God; make all of dem bigin praiz and sing for joy! 5 Make dem sing dia praiz give God with harp, sweet-sweet songs, 6 trumpets and di sound from ram horn. Make una sing with praiz, before di King wey bi awa God. 7 Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God! Make di eart and evry living tin join dem too. 8 Make di rivers klap dia hand as dem dey praiz God. Make di hills sing dia song for joy 9 before awa Oga God, bikos E dey kom judge di whole world. E go judge di whole world well kon judge evribody, with raitiousness. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.