Psalms 93 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishNa God Bi King 1 God na king and en glory wey dey shine well-well, kover evriwhere. True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa. Di world stand gidigba and nor-tin fit shake am. 2 My God, yor throne don dey even before Yu kreate di world. Yu yorsef, don dey forever and ever. 3 My Oga God, even doh rivers dey full and make nois like tonda as dem dey go up-and-down, 4 Yu wey dey up, strong pass di waves and river wey dey rush with speed. God get pawa pass all dis tins! 5 My God! Nobody fit shange yor laws! Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.