Psalms 87 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishJerusalem Song Korah Shidren Song 1 Di town wey God build by ensef, dey for di holy mountin. 2 God love Jerusalem pass any oda town for Israel. 3 Si as pipol dey tok good tins about yu Jerusalem wey bi God town! 4 I go kount Egypt and Babilon join di towns wey know mi. I go still kount Filistia and Tyre plus Ethiopia town join dem. All of dem dey sey dem born dem for Jerusalem! 5 But for Jerusalem real pipol, odas go sey, “Una dey enjoy o-o, bikos una bi Jerusalem pipol.” And di Most High God go bless di town by ensef. 6 Wen God dey kount and rite en pipol name for en book, E go sey, “Dem born dis ones sef for Jerusalem.” 7 So di pipol go blow trumpet kon sing sey, “Na Jerusalem bi di hope wey wi get!” |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.