Psalms 75 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishNa God Bi Judge Asaf Song For Di Kwayamasta 1 My God, wi tank Yu! Wi dey tank Yu bikos Yu dey near us and pipol for evriwhere dey tok about di wonderful tins wey Yu dey do. 2 God sey, “Wen di time wey I choose don rish, I go judge pipol. 3 Di eart go shake and evribody go fear, bikos na mi make di foundashon. 4 I don warn proud pipol sey, ‘Make dem stop to dey make mout!’ kon tell wiked pipol sey, ‘Make una nor dey happy sey una don win! 5 Make una nor tink sey una don win di fight or karry body up wen una dey tok.’ ” 6 Viktory nor dey kom from east or west or from di wildaness, 7 bikos na God dey judge! E dey bring one pesin down and karry anoda pesin up. 8 One cup wey full with wine wey dem mix with spice, dey for God hand and E pour am for di world. True-true, all di wiked pipol for di world go drink from am till e finish. 9 But for mi, I go always dey tok about wetin Yu don do; I go sing and praiz Jakob God! 10 God sey, “I go distroy wiked pipol with dia pawa kon give viktory to pipol wey dey fear mi.” |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.