Psalms 61 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPrayer For Proteshon David Song For Di Kwayamasta 1 My God, make Yu hear as I dey kry! Make Yu hear mi as I dey pray for help! 2 From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help, bikos trobol don make my heart heavy. Karry mi go di high mountin, where I go for dey save. 3 True-true, na Yu dey save mi; my strong towa wey dey protet mi from my enemies. 4 Make Yu let mi stay yor temple forever, den I go dey save under Yu. 5 Yu know wetin I promise and Yu don give mi di reward wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu. 6 Mi wey bi king, make Yu give mi long life, so dat I go si my shidren-shidren! 7 Make di king rule with God proteshon forever. Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king. 8 Den, I go dey sing praiz yor name forever kon dey do wetin I promise Yu. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.