Psalms 54 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPrayer For Proteshon From Enemies David Song For Di Kwayamasta Wen Zif Pipol Go Ripot Am 1 My God, make Yu kom with yor great pawa kon save mi! Make Yu defend mi with yor strent. 2 My God, make Yu listin to my prayers. Make Yu listin to mi as I dey beg. 3 Bikos strenjas dey attack mi; wiked pipol dey try to kill mi and dem nor kare about God. 4 But na God dey help mi. Na God dey keep my life! 5 Make evry wiked plan wey my enemies dey plan, turn back go meet dem. 6 I go just give Yu sakrifice on my own! My Oga God, I go praiz yor name, bikos e dey good and 7 Yu save mi from my trobols kon help mi defeat my enemies. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.