Psalms 52 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishGod Judgement And Grace David Song For Di Kwaya Leader. E rite am wen Doeg from Edom go meet and tell Saul sey David don go Ahimelek house. 1 Yu wey tink sey yu strong, why yu dey karry body for di bad tins wey yu dey do? Yu nor know sey God love dey always protet mi? 2 Evriday, na how yu go take distroy pipol yu dey plan. Yor tongue dey kut pipol like razor blade and yu sabi lie well-well. 3 Yu like bad tins pass good ones and yu love lie-lie pass trut. 4 Yu wey dey lie well-well, yu like to distroy odas with yor words! 5 But God go distroy yu wons and for all. E go remove yu from yor house kon distroy yu from dis world. 6 Doz wey dey do wetin dey rite, go si am kon happy. Dem go laf dey sey, 7 “Si wetin happen to dis man wey nor trust God and tink sey e strong. E trust en money kon dey happy for di wiked tins wey e dey do.” 8 But I bi like olive tree wey dey grow well inside God house. I go always trust God love wey nor dey fail. 9 My God, I go praiz yu forever, bikos of di tins wey yu don do. I go always dey trust Yu, bikos pipol wey dey obey Yu, know sey Yu dey good. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.