Psalms 47 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishNa God Dey Rule Di World David Song Wey Korah Shidren Sing 1 Evribody! Make una kom! Make una klap una hand! Make una shaut praiz God with klean mind! 2 Bikos di Most High dey good! Na-im bi di great King for di whole eart. 3 E distroy di pipol wey dey before us kon put awa enemies under awa leg. 4 E choose and give us di Promise Land as awa propaty for life; di place wey dey make Jakob shidren-shidren happy; di shidren wey God love. 5 God dey waka go en throne and pipol dey shaut and blow trumpet as E dey go. 6 So, make una sing praiz God; make una praiz am; make una sing praiz to awa King, make una sing praiz am! 7 Na God bi di King for all di eart. Make una praiz am with psalms! 8 Na God dey rule all di nashons, even as E sidan for en holy throne. 9 Di rulers for di world gada togeda with Abraham and God pipol, but bikos na God bi di King of evry king, make una honor am for evriwhere for di world. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.