Psalms 41 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishMan Wey Dey Sick, Prayer David Song For Di Kwayamasta 1 Na blessing go follow doz wey dey do good for poor pipol! God dey always save dem from trobol. 2 Make God protet and keep dem alive. Make E make dem prosper for di land and save dem from dia enemies. 3 God dey kare for dem wen dem dey sick kon make dem well again. 4 My God, I dey pray sey, “Make Yu sorry for mi. Make Yu heal mi, bikos I don sin against Yu.” 5 Na only bad-bad tins my enemies dey tok about mi. Dem dey ask, “Wen e go take die make pipol forget am?” 6 Dem dey visit mi like sey dem bi my friends, but na wikedness full dia heart and wen dem komot from where I dey, dem go-go spoil mi give evribody. 7 Pipol wey hate mi dey tok for each oda ear about mi and na only bad tins dem dey tink about mi. 8 Dem sey, “E get some bad-bad diziz. E nor go ever get up from dat bed!” 9 Even my best friend, di one wey I trust with evritin; pesin wey wi dey chop togeda, don turn against mi. 10 So Oga God, make Yu sorry for mi. Make I well again, so dat I go pay dem back! 11 Like dis, I know sey I dey make belle sweet Yu, bikos Yu neva let my enemies win mi. 12 Instead, Yu don keep my life, bikos I dey innocent; Yu don let mi enter yor present forever. 13 So make una praiz di Oga wey bi Israel God, bikos E dey alive forever and ever. Amen! |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.