Psalms 4 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPrayer For Help For Evening For Di Kwayamasta: David Song 1 My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu. Na only Yu go fit diliver and free mi from wiked pipol and all my trobol. Make Yu sorry for mi kon hear my prayers. 2 Na how long pipol go take dey tok bad about mi? How long una go dey tok wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie for my head? 3 Make una know sey, God dey keep doz wey dey fear am for ensef and E go ansa wen wi koll am. 4 So make yu fear God and nor sin. Make yu tink about am for nite kon turn from yor sins. 5 Make yu offa sakrifice with di rite spirit give God kon trust am. 6 Many pipol dey sey, “Who go fit show us wetin dey good?” So my God, make Yu smile for us. 7 Yu don give mi more joy pass doz wey get many food and wine to drink. 8 I dey sleep with peace, bikos na only Yu wey bi my God, dey save mi. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.