Psalms 29 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishGod Tok Inside Tonda David Song 1 Make all di angels for heaven honor God; make una honor am, bikos of en glory and strent. 2 Make una honor God, bikos en name get glory. Make una woship God, bikos of en holiness. 3 God vois dey sound on-top di sea and en vois bi like tonda, bikos na en bi di God wey dey kause tonda on-top strong sea. 4 God vois get pawa well-well; en vois get glory. 5 God vois dey break mighty cedar tree! Yes, e dey skata cedar trees for Lebanon. 6 E make Mount Lebanon dey shake like small animal kon make Mount Hermon dey jump like small melu. 7 God vois dey kom with strong lite. 8 God vois dey make di wildaness shake. Yes! En vois dey shake Kadesh Valley. 9 God vois dey bend big trees and skata leaf for forest. Evribody for di temple dey sey, “Make glory bi yor own!” 10 Na God dey rule ova wota and E go bi king forever. 11 Na God dey give en pipol strent and na en dey bless dem with peace. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.