Psalms 146 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPraiz God Wey Dey Save Us 1 Praiz God! My soul, make yu praiz God. 2 I go praiz God as long as I dey alive. Even if I dey die, I go sing praiz to God. 3 Make yu nor trust pipol wey get pawa; bikos dem nor go fit help yu. 4 Wen dem don die, dem go-go back to di groun and all dia plans go die with dem. 5 But pipol wey Israel God bi dia helpa and hope, dey inside di Oga God and na joy dey follow dem. 6 Na God make heaven and eart, di sea and evritin wey dey inside dem. E dey keep all di promise wey E make. 7 Pipol wey dem dey opress, E dey judge dia kase well and dey feed doz wey dey hongry. God dey free pipol wey dey prison. 8 God dey open blind pipol eyes kon karry doz wey dey weak, go up. God love pipol wey dey fear am. 9 God dey guide di strenjas among us. E dey kare for pipol wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, but E dey ponish wiked pipol with dia wiked plans. 10 So God go rule forever. Jerusalem pipol, E go bi una God from one generashon go rish anoda. So, make wi praiz awa God! |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.