Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -

Psalms 141 - Holy Bible Nigerian Pidgin English


Prayer For Evening
David Song

1 My Oga God, I dey koll Yu, so make Yu kwik kom! Make Yu listin wen I kry to Yu for help!

2 Make Yu asept my prayers like incense wey dem offa give Yu and di hand wey I take dey praiz Yu, asept am like ofrin wey pipol dey give Yu for evening.

3 My God, make Yu help mi kontrol my mout kon guide my lips.

4 Nor let mi waka enter evil or follow pipol do bad tins. Nor let mi chop sweet food wey wiked pipol kook.

5 Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love! Make my head nor rijet good oil! True-true, even with all dia wiked plans, my prayers dey make dem fear.

6 Wen dem trow dia leaders down from rock, di pipol go kom listin to my word wey go diliver dem.

7 Just as pesin dey klear and dig groun, na so too wiked pipol bones skata for dia grave mout.

8 But my Oga God wey get pawa, I dey look up to Yu. Na Yu bi my guide; so make Yu nor let dem kill mi.

9 Make Yu keep mi from di trap wey dem don set for mi; di hole wey wiked pipol dig.

10 Make Yu let wiked pipol fall enter dia own trap and free mi from dia trobol.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Wycliffe Bible Translators, Inc.
Lean sinn:



Sanasan