Psalms 132 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPraiz For Di Temple David Song 1 My God, make Yu remember David and all di sofa wey e sofa. 2 E make promise give Yu and E vow give di Oga wey bi Israel God sey, 3 “I nor go-go my house or go sleep for my bed. 4 I nor go gri sleep or let sleep katch mi 5 until I find di place where I go build God house put; one big temple for di Oga God wey dey save Israel.” 6 Wi hear sey di Kovenant Box dey for Efrat; den wi si am for Jaar town. 7 Make wi go God temple; make wi woship am for front of en throne. 8 My God, make Yu raiz-up kon enter yor place where rest dey, with di Kovenant Box wey dey show yor pawa. 9 Make yor glory kover yor priest; make joy full yor loyal savants heart. 10 Bikos I bi yor savant, make Yu nor rijet mi David, di king wey Yu choose. 11 God promise David di kind promise wey nor go shange sey: “I go put one among yor shidren for di throne. 12 Den if yor shidren-shidren obey di kovenant and di laws wey I tish dem, dem go bi king forever.” 13 Yes! God don choose Jerusalem; E don choose di town as en own 14 and E sey, “I go dey rest for here forever. I go stay der, bikos na mi choose am. 15 I go bless dis town kon make am prosper. Den I go dey feed di poor pipol wey dey di land. 16 I go protet en priests and joy go full di heart of doz wey dey fear God. 17 For der, I go make David pawa strong; bikos I don decide sey, en shidren-shidren go bi king forever. 18 I go disgrace en enemies and David kingdom go rule forever.” |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.