Psalms 131 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPrayer For Trust David Song 1 My God, my heart nor dey proud; my eyes nor dey look anyhow. I nor dey worry mysef with matter wey too heavy for mi to bear. 2 Instead, I dey kwayet and dey silent like pikin wey nor dey kry for breast milk again. Yes, I kwayet like pikin wey en mama karry. 3 So Israel pipol, make una put una hope for God hand, both naw and forever more! |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.