Psalms 130 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPrayer For Help Solomon Song 1 My God, I dey kry kom meet Yu with pain for my heart. 2 My Oga God, make Yu listin and hear mi as I dey kry for mesi! 3 If to sey Yu, my God won kount all di sins wey pesin kommit, den na who go fit stand before Yu? 4 But Yu always dey ready to forgive so dat dem go honor Yu. 5 So, I put my hope for God hand, I trust am with my whole life and I dey wait for en word wey nor dey fail. 6 Di way I dey find God, sirious pass as gateman dey wait make day break. Yes o-o, e sirious pass as gateman dey do for morning. 7 So Israel pipol, make una put una hope for God hand, bikos God dey show en love and E always dey ready to save en pipol. 8 E go diliver Israel pipol from di wahala wey dem dey face, bikos of dia sins. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.