Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -

Psalms 129 - Holy Bible Nigerian Pidgin English


Prayer Against Israel Enemies
Solomon Song

1 Make Israel pipol sey, “Na since wi dey small awa enemies don dey opress us.

2 Even doh enemies dey attack us since wi dey small kom rish naw, dem neva ever fit win us.

3 Dem don use cutlass kut all awa back like sey na farmer klear am.

4 But God dey good; E don kut di rope wey wiked pipol take tie us and naw, wi don dey free.

5 So, make evribody wey hate Jerusalem, turn back with shame.

6 Make dem dey yuzles like grass wey dey on-top roof, wey go die as e dey grow

7 and pipol nor go plok or si am again.

8 Yes! Pipol wey dey waka pass nor go sey, ‘Make Oga God bless dem’ or sey, ‘Wi bless una with Oga God name.’ ”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Wycliffe Bible Translators, Inc.
Lean sinn:



Sanasan