Psalms 128 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishTo Obey God Dey Pay Solomon Song 1 Make una si di blessing wey dey follow doz wey dey fear and do wetin God kommand. 2 Yu go enjoy wetin yu dey work for! Yes! Yu go dey happy and sikure. 3 Yor wife go bi like vineyard wey get betta fruit and e go prosper for yor house. Yor shidren go bi like yong olive tree. 4 Yes! True-true, dis na God blessing for doz wey dey fear am. 5 Make God always dey bless yu from Zion. As long as yu dey alive, yu go si Jerusalem dey prosper. 6 Yu go live to enjoy yor shidren-shidren. Make peace always dey Israel land! |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.