Psalms 126 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPrayer To Diliver David Song 1 Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream! 2 Wi bigin laf kon dey sing for joy. So di oda nashons kon sey, “Di Oga God don do good tin for dis pipol o-o.” 3 Yes, God don do betta tin for us, so awa joy don plenty! 4 Oga God, just as wota dey make dry land fresh, na so too Yu go do for us wen Yu give us awa propaty back. 5 Pipol wey sofa plant dia seed, go harvest wetin dem plant with happiness. 6 Dem dey kry as dem dey go plant dia seed, but dem go dey sing with joy as dem dey kom back with wetin dem harvest. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.