Psalms 125 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishGod Pipol Dey Save David Song 1 Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever. 2 Just as mountin gada round Jerusalem, na so too God dey round en pipol, both naw and forever. 3 Wiked pipol nor go rule pipol wey dey fear and obey God, if not, doz wey dey obey God fit start to do bad tins too. 4 My God, make Yu do good to pipol wey dey good; doz wey dia heart and mind dey with Yu, 5 but make Yu ponish pipol wey dey do bad tins. Ponish dem with all di oda wiked pipol. Make peace always dey Israel land! |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.